BREAKING: Whitemoney BBNaija biography: Whitemoney wins Big Brother Naija Season 6, Liquoros comes Second (PIDGIN)

Spread the love

Whitemoney don win Big Brother Naija season six.

Im beat Liquorose wey reach di last two stage through di way fans vote.

Pere finish third
From wildcard to second runner up, Pere journey for Big Brother Naija house don end.

Im leave behind Whitemoney and Liquorose as di last man standing.

https://www.sojworldnews.com/breaking-angel-evicted-from-bbnaija-season-6/

Pere use im eviction interview to declare im love again for Maria, but “as a friend”.

Pere tell Ebuka say im dey go into Nollywood now wey im don comot for di house.

Cross say bye-bye
Cross also don say bye bye to di Big brother house as di number four man standing afta 10 weeks of intense competition, tasks plus fun.

https://www.sojworldnews.com/one-of-the-best-igbo-surgeon-in-nigeria-shot-dead-in-anambra/

“I dey too blessed!” Cross tok as im bin think say im go make am to be top three housemate for di show.

Cross tok say wetin dey next for am na to go into entertainment, business and politics.

How Pere win brand new car
Highlights from di last Saturday night party of BBNaija S6
Angel and Emmanuel finish fifth and sixth
Before Pere and Cross comot, Emmanuel and Angel bin don chop eviction among di top six for di finale of BBNaija.

https://www.sojworldnews.com/adekunle-ajasin-university-lecturer-kidnapped-narrates-nasty-experience-to-wife-on-phone-from-custody/

Emmanuel tok afta im eviction say “im dey surprised to make am dis far for di show.”

Im bin no expect am say im go make am till di final.

Angel say she feel great say she don finally dey out of di house as she bin don tire – she tok am jokingly.

Di second female housemate to reach di final add say she dey excited to be part of di show.

Angel dey look forward to start mental health blog afta now.

https://www.sojworldnews.com/senate-minority-leader-abaribe-fires-buhari-over-independence-day-broadcast-a-must-read/

Wetin be dis season prize money?
Dis season winner go walk away wit di ogbonge grand prize of N90m.

Di N90m grand prize include N30m cash prize, cash in Abeg digital wallet, bitcoins courtesy Patricia, one two-bedroom apartment courtesy RevolutionPlus Property, a top of di range SUV from Nigerian automaker, Innoson Motors and a trip for two wey Travelbeta package.

See BBNaija past winners
Big Brother Nigeria 1 Katung Aduwak $100,000
Big Brother Naija 2 Efe Ejeba N25,000,000
Big Brother Naija 3 Miracle Igbokwe N45,000,000
Big Brother Naija 4 Mercy Eke N60,000,000
Big Brother Naija 5 Olamilekan Agbeleshe N85,000,000

Join SOJ WORLDWIDE ONLINE NEWS anywhere you are across the globe on WHATSAPP BROADCAST LIST for our latest news updates with this number: 09069473894.

Engage us to create awareness and publicity and also to promote your products and services including your political aspirations no matter your political affiliations at minimal charges.

We have our presence in Opera.com, Nairaland, Phoenix Browser and we are Google approved.

SOJ WORLDWIDE…ONLINE NEWS with a difference.

About Bola Ogunmuyiwa 1588 Articles
BSc Agric Science

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*


This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.